Guest Sign UpLoginNew PostSections ₦0What's Up?DownloadsShopChatToolsAdvertise
Join the Publishers' Program. Get paid for writing.
Recharge DSTV, GOTV, StarTimes, & PREPAID METERS on https://billy.africa




U dey do opening prayer for 3am
in d Night Club.
( Na God go slap ur mouth.)
U come back from dubai after
 2weeks dey form British accent.
(Jolly jus come)
U be house boy u come dey play
Rick Ross - I am the
 Boss.
(for how na.....mumu)
U dey add water to egg say e for
 plenty when u fry am.
( Why u no kukuma add yeast
 na....olodo).
U no go university, and u dey
 find ur name for NYSC
 postings.
(Na yeye dey worri u.)
House dey burn, you wan use gas
 do fire extinguisher
.( Hahahahaha....Na u get sense
 pass)
U dye say Terry G's music dey
 inspire u
( unto which level na)
U carry candle dey look for
 where fuel dey smell from.
(continue na,u go soon see am)
U call MTN to tell dem sey ur free
 browsing has stopped
 working.
(Lolzzzzzzzzz...Oshofree don carry
 go)
When pastor talk say 'Do
 something crazy for the Lord'
 u come carry church offering run
(na who wan chase
 u na?.
 )
Finaly U read dis finish and u no
 come like or share am(haba
 nau,na stingyness dey worry
 u..lol)


Slick
U make sense

Oluwatoye







Top SectionsSee More

Trending
This forum does not have any topics.

Top Posters This Month (500 Credits)
(See More)